Observation of premier league week 3

This week premier league tough o. Well Maka quick quick talk the few things when I observe.
1) Manchester United they vex unto say Don till well well them carry the league.

2) Chelsea Na champions. When burnley knack them Yanch for opening day everybody feel say them wan fuck up this season. But Na lie.the blues dey fly

3) Liverpool nor need coutiho. As them trash arsenal Yanch yesterday I notice say coutiho self nor even dey needed for the squad.

4)Man city go flop this season. Na after mingle mingle nai the club when spend 200million plus fit beat Bournemouth when nor even spend 20million. Abeg that one Na team?

Make una choke mouth put. Waitn una self observe

Comments